Instagram story viewer> @stretchoriginal> Posts
2.8K
followers
1158
following
Programs Manager Wazobia 95.1 Lagos. Media Consultant, Correct FM 104.3 Lagos,,Cool FM Lagos,Cool FM PH,Cool Wazobia Info Abuja@
POSTS STORIES REELS TAGGED
 by @stretchoriginal
0
18 days ago
Download
Senator Francis Fadahunsi, wey dey represent Osun East Senatorial District, don explain wetin e really mean with him “Kill Accord” comment wey don go viral for social media.

For the video, dem see Fadahunsi dey speak Yoruba, and e accuse members of Accord Party say dem attack members of All Progressives Congress (APC). E also tell the people wey gather for there to attack Accord Party supporters for Ilesa.

How u see di mata? #chookmouth by @stretchoriginal
13
2 months ago
Download
Presido Bola Tinubu don direct Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) make dem comot court order wey freeze account wey belong to Osun State Government.

How u see dis mata? #chookmouth by @stretchoriginal
1
2 months ago
Download
Six Nigerian governors don promise say dem go carry wetin dem learn from Glo-Djigbé Industrial Zone (GDIZ) for Benin Republic come use for dia states, as part of plan to grow agriculture, bring manufacturing back to life and create more jobs.

Dem make the promise after dem follow Vice President Kashim Shettima go inspect the industrial zone wey dey near Cotonou, where dem dey process farm produce like cotton, cashew nuts and soybeans turn am to finished and semi-finished products.

Governors wey follow the trip na Hope Uzodimma, Dauda Lawal, Caleb Mutfwang, AbdulRahman AbdulRazaq, Dikko Umar Radda and Umar Namadi. #chookmouth by @stretchoriginal
40
3 months ago
Download
With insecurity, hunger, high cost of living and oda serious wahala wey full Naija, na bus preaching bill Senate suppose dey defend?

You think say dis bill na wetin Nigeria need pass now?
Abi Senate suppose focus on di beta pressing issues first?

Drop your mind for comment section. Make we reason am together. 
#chookmouth

🎙️ Townhall | Monday–Friday | 8AM–9AM
📺 Full video dey our Facebook & YouTube channel

#senate #explore #politicsnews #bills by @stretchoriginal
1
3 months ago
Download
First Lady, Oluremi Tinubu, don tok say if her husband, President Bola Tinubu, win second term for office, she go dey wear Akwete wrapper.

She tok dis one on Tuesday during her visit to Akwete Weaving Cooperative Village for Abia State, where she announce say she go donate ₦2 billion make dem revive di local weaving business. #chookmouth by @stretchoriginal
33
3 months ago
Download
INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan (SAN), tok dis one on Thursday as e receive British High Commissioner to Nigeria, Dr. Richard Montgomery, wey come pay courtesy visit for INEC headquarters for Abuja.

According to am, INEC dey plan to audit all dia election systems before di 2027 general election. Dem still dey consider to organize one mock presidential election, so dem fit test whether dia processes and technology don ready before di real election. #chookmouth by @stretchoriginal
1
3 months ago
Download
Nigeria First Lady Oluremi Tinubu don call Afrobeats superstars Burna Boy, Davido and Asake make dem use foundation help Nigerians wey dey suffer.

Remi Tinubu tok dis one for Lokoja, Kogi State, on Saturday, as she launch the national community food bank.

She talk say: "Burna Boy, Asake, Davido and all of una. We wan see make una get one foundation or the other wey go dey help poor people with una money.

"Fine cars good. Maybach good. Rolls-Royce sef good. But even with all those things, una still fit help people. The work wey dey government hand too plenty." #chookmouth 

#remitinubu #burnaboy #davido #asake by @stretchoriginal
8
3 months ago
Download
Federal Ministry of Education don approve make NECO and WAEC increase registration fee for dia Senior Secondary Certificate Examination (SSCE) to ₦50,000 for each candidate, and dis new fee go start from 2027. 

You gree say as WAEC fee don increase, e fit make more students comot school? #chookmouth by @stretchoriginal
43
3 months ago
Download
For Townhall, Mazi chook mouth for the viral video wey show police officers hailing men wey many people allege say na bandits as dem pass on top bike.

According to am, the police officers do well by not confronting the men immediately, especially if dem no get enough backup or intelligence about who dem be.

The comment don spark debate:

Na wisdom or negligence?
Wetin you expect the police to do for that situation?

You sef fit #chookmouth 

📡 Catch Townhall LIVE | Monday–Friday | 8AM–9AM 
📺 Full video dey our YouTube channel

#bandits #poliçe by @stretchoriginal
4
4 months ago
Download
Presidential spokesman, Bayo Onanuga, don tok say e no gree with people wey dey say hunger too much for Nigeria, he say plenty Nigerians don dey enjoy benefits from di policies wey President Bola Tinubu government put in place.

Onanuga yarn dis one during interview for Arise Television on Tuesday. E tok say several government programmes don help citizens well-well, including infrastructure projects, student loan scheme and credit facilities for workers.

As e dey remember one journey wey e make from Ibadan go Lagos, Onanuga say e surprise when e see one newly-built concrete road around Ijebu-Ode area.

E say: “One day, as I dey travel from Ibadan go Lagos, Google Maps tell me say traffic heavy as person dey approach Lagos. So I decide say make I pass Ijebu-Ode through Shagamu. Wetin shock me pass be say I just find myself for one smooth concrete road. I come ask, ‘Wow, when dem take build this one?’”

E add say di road don change how people for di area dey see government work.

“I discover say our people, I mean di Ijebu people, don stop to dey complain. I come say, ‘Oh, na why. Dem don get brand-new road wey no be ordinary asphalt road, but concrete road,’” Onanuga tok. #chookmouth by @stretchoriginal
24
4 months ago
Download
OC Wire don finally open him famous School of Hustlers and Mazi don rush go register! 😂💸

But shey Mazi go finally make am... or na another premium disappointment dey wait am? 😭🤣

Find out on the latest episode of AWA YARD!

📺 Now showing on Wazobia XTRA YouTube Channel
🔗 Link in bio

#AwaYard #OCWire #SchoolOfHustlers #WazobiaXTRA #NaijaComedy #NigerianComedy #ComedySeries #NollywoodComedy #AfricanComedy #FunnyVideos #LatestNigerianComedy by @stretchoriginal
18
4 months ago
Download

Download All

Save the photos and videos currently loaded on this page.

0Photos
0Videos
Ready to download 0 / 0

Keep this tab open until your download is ready.

back to up