Instagram story viewer> @wazobiafmph> Posts
3200
posts
44.3K
followers
65
following
Your number 1 pidgin Station for Port Harcourt.
Call us to #ChookMouth: 📲 0700 941 941 941 || 080 9030 6414
POSTS STORIES REELS TAGGED
Download All
Govoo Siminalayi Fubara don declare say him dey support Kingsley Chinda, wey be governorship candidate of All Progressives Congress (APC). Di govoo still endorse Presido Bola Tinubu make eim serve second term, and eim announce say him go join Rainbow Coalition, one political alliance wey Minister of FCT, Nyesom Wike, dey lead.

Govoo Fubara make dis announcement on Wednesday during di groundbreaking and foundation-laying ceremony of Riven Medical Industries Project for Rumuosi, Obio/Akpor Local Goment Area. As him dey tok to eim supporters, di govoo tell dem make dem no expect anything from am, but make dem identify with and support di Rainbow Coalition instead.

As eim dey tok about di medical industries project, Govoo Fubara say di Rivers State Goment partner with di investors becos of di plenty benefits wey di facility go bring give Rivers pipo and di state economy. Him tok say e get confidence say dem go complete di first phase of di project within three months.
.
#WazobiaFMPH
#chookmouth taken in Wazobia Fm 94:1 by @wazobiafmph
0
3 days ago
Download
Today ontop #AsEDeyHot with @ogankate8 

📌 Port Harcourt Ring Road development at what cost

Di original 36-month time wey dem talk say dem go take finish di project don pass.

📌 You dey satisfied with di speed wey work dey go? Abi you feel say government and di contractor suppose do more to reduce di suffer wey di communities wey dis project affect dey face while di work still dey continue?

#WazobiaFMPH
#AsEDeyHot
#chookmouth by @wazobiafmph
0
4 days ago
Download
#PitakwaHowUnnaSeeAm with @ladyofficialj 

Today, a mama of a 31 year old man wey dem kpai for inside Port Harcourt come our station dey cry for Justice for her pikin wey dem bin kpai becos of some kata kata wey bin involve dispatch rider. 

She tok sai na one member of Airforce wey kpaii her pikin and now she dey fain justice for her pikin but di problem be sai, even now, we neva hear anything from di Airforce .

📌Why e be sai we neva still hear anything from di Airforce pipo?
.
#chookmouth 
#wazobiafmph by @wazobiafmph
0
4 days ago
Download
For Wazobia FM ehn, evidence choke no be chochocho😂😂

Come visit us today make you sef follow book one or two😊😊

#WazobiaFmPh
#Chookmouth by @wazobiafmph
6
4 days ago
Download
Headline of interest for #OgaMadam Office Show, with @afeeturi 

Flood wahala don worse as many Rivers residents dey count losses and dey run comot from their houses.

Ogoni group don drag HYPREP go court over alleged ₦62.5 billion project money.

📌 Which one pinch you pass for body?
.
#wazobiafmph
#chookmouth by @wazobiafmph
0
5 days ago
Download
Four months after di painful death of two-year-old Miss Wynne Akekue wey make goment close Wisdom Gate International School for Eligbolo campus, di Rivers State Goment don announce say di school fit reopen.

Di Rivers State Ministry of Education remove di suspension for one statement wey di Commissioner, Dr Peters Nwagor, sign. Nwagor tok say dem take dis decision after di Ministry of Education carry out thorough investigation, wey show say di school don meet all di required safety standards and don improve dia facilities as goment instruct dem.

Make we remember say Rivers State Goment suspend di operation of di school Eligbolo campus for April afta Miss Akekue kpai. Report tok say di two-year-old pikin kpai on March 17 afa one bookshelf fall on top of am while she dey sleep for one classroom.

Di case currently dey before one State High Court for Port Harcourt. Di proprietor of Wisdom Gate School and four management staff for di Eligbolo campus dey face accusate say dem get hand for di death of di small pikin.
.
#WazobiaFMPH
#chookmouth taken in Wazobia Fm 94:1 by @wazobiafmph
0
9 days ago
Download
We been siddon yarn with @realcoconuthead1, as eim been tell us how eim take start dis eim journey to dey help carry pipo go rehab make dem fit dey alright. Abeg say no to drugs, e no good to dey misuse am

#wazobiafm
#chookmouth by @wazobiafmph
14
12 days ago
Download
Nigerian Army don rescue di 44 pupils and teachers wey kidnappers carry comot for Oriire Local Government Area, Oyo State, after dem spend 56 days for captivity.

According to Army, na long intelligence operation wey involve plenty security agencies and local vigilantes make di rescue possible.

Army tok say no be only to rescue di victims be di mission. Dem also trace di kidnappers’ leaders, scatter their logistics network, arrest suspects for Oyo and oda states, destroy dia hideouts for Old Oyo National Park and put enough pressure on di criminals before dem release all di captives. Dem still confirm say some security officers lose dia lives during di operation.

Many Nigerians don welcome di successful rescue, but e still raise important questions. If security agencies fit achieve dis kind success through beta intelligence and teamwork, wetin goment go do to stop school kidnappings before dem happen? And how dem go sustain dis collaboration to stay ahead of criminal gangs?

📌 Wetin be di policy or beta plans wey Federal and State Goments suppose put in place to reduce kidnapping and make everywhere for Nigeria safer?

#WazobiaFMPH
#chookmouth taken in Wazobia Fm 94:1 by @wazobiafmph
0
13 days ago
Download
Rivers State Govoo, Siminalayi Fubara, go present di 2026 budget proposal give Rivers State House of Assembly today.

Dis budget presentation dey come two weeks after di lawmakers approve di 2026 to 2028 Medium-Term Expenditure Framework (MTEF) wey di govoo submit. Di framework project say di 2026 budget go reach about N1.84 trillion. Dem don set aside more than N400 billion for recurrent expenditure, while over N1.4 trillion go for capital projects.

Make we remember say Speaker of di House, Martin Amaewhule, during di presentation of di MTEF report, praise di executive for putting together one financial plan wey go help direct di state's development for di next three years. But di Speaker still show concern about di revenue projections inside di framework. According to am, di figures wey di executive present no match di current economic reality, especially if person look di current international crude oil prices. 

#wazobiafmph 
#chookmouth taken in Wazobia Fm 94:1 by @wazobiafmph
0
16 days ago
Download
As pesin wey be pikin guardian, you need to protect di pikin, provide for di pikin and project dat pikin.

We dey see now sai a lot of guardians no dey do all dis things for pikin wey dem give dem hold and even dia own pikin, as we see for inside one video today.

📌 Which beta way dey wey parents fit use discipline dia stubborn pikin dem?
.
#chookmouth 
#wazobiafmph by @wazobiafmph
0
18 days ago
Download
Today on top #AsEdeyHot with @ogankate8 

Federal Goment Don Meet Oil Marketers as Nigerians Dey Demand Make Dem Reduce Petrol Price
.
#wazobiafmph 
#chookmouth taken in Wazobia Fm 94:1 by @wazobiafmph
1
19 days ago
Download
Di Govo of Oyo state wey be Oga Seyi Makinde yarn sai, di Presido neva call am to ask am Howfar. 

Na eim make Oga Peter Obi dey tok sai make we Presido commot for seat, unto sai eim never do anytin since dem carry dis children

📌If Presido sai eim wan commot for office, who you tink sai go come change di kata kata for naija.
.
#chookmouth 
#wazobiafmph by @wazobiafmph
0
19 days ago
Download
×

Download all media on this page

Photos Videos
back to up